Priesst – Akonuche (Lyrics)

The remarkably talented vocalist musical artist Priesst unveils his latest soulful and captivating single track titled “Akonuche”.
Read Priesst – Akonuche (Lyrics) Below
Na you go decide
This year I dey cut my coat oversize
I no trek reach this point just to stop here
If tables no turn for my favor, I go change position
Wetin people go talk no concern me
God dey my side, so fear no dey
I go move with Akonuche
Pass Ebuka, I stubborn
I leave shame behind like bumbum
From Abuja straight to London
This year dem go know say I don land
I dey do smart work, no be force
Las Vegas dreams, no be just Lasgidi
I no dey idle
If na useless movement, I no get time
I don hard now, you fit see am?
Since 2015 I dey sing nonstop
You fit try am if you feel say e easy
E fit shock you like dream wey catch you for sleep, I swear
One day my papa go pull up with brand new truck, my mama by his side
Wetin my eyes don see, mouth no fit explain am
Go ask Ebuka, I stubborn
I leave shame for back like bumbum
From Abuja to London
This year dem go know say I don come
Pass Ebuka, I stubborn
Shame no dey follow me again
From Lasgidi to London
This year dem go know say we don come
⬇ DOWNLOAD MP3
Do you find Naijaslide useful? Click here to give us five stars rating!